fbpx
April 19, 2024

Old 500 and 1000 Naira notes na legal tender now – CBN

old-naira-notes-na-legal-tender-cbn

Di acting Director of Corporate Communications, Dr. Isa Abdulmumin of CBN don open up say both old and new Naira notes na legal tender now.

Isa Albudlmumin

 

FOR MORE NEWS: Kenyan first lady lead prayers against homosexuality

You go remember say last week, di Supreme Court give dia verdict on di Naira redesign, and dem direct di federal government make dem allow di validity of N200, N500, and N1000 notes till 31 December.

According to di report from CBN acting director, Isa confam am say commercial banks don start to dey give dia customers both old and new notes as dem be legal tender. Although di apex bank neva still drop any official statement.

Na wetin hin tok be dis:

“Banks are paying old notes as well as new notes. They are all legal tender.

Yes, the CBN has not issued an official statement on the issue. Anyone banks give to you, you can collect. We just want to make life easy for Nigerians. No. They can’t reject it. It’s all legal tender,”

You fit o read di full gist…READ MORE