fbpx
April 25, 2024

OSPOLY: NAUS praise Gov Adeleke over new school fee suspension

0

Di National Association of University Students, Osun Campus Monitoring Committee, don praise di state governor, Senator Ademola Adeleke, over di suspension of new school fee implementation for Osun State Polytechnic, ” Iree”

According to report inside one memo signed by di Permanent Secretary, Osun State Ministry of Education, Adelani Aderinola, lnside one copy of di memo wey tori pipol collect on friday for Osogbo, tok say make dem suspend di new school fee.

U FIT ALSO READ Allocate 26% of Nigeria annual budget to education – Don tell FG

Di memo tok say according, to di acting Rector of di polytechnic, dated December 15, indicate say di new fee go take effect from 2023 wen new academic session commence.

NAUS inside one statement on Saturday signed by dia chairman and deputy, Eruobami Ayobami and Oyedele Omowunmi, claim say “ di school fee for new students bifore bifore na (N67,850) but later dem increase am to (N112,850) only for students wey dey offer science courses while those who dey offer management courses bifore bifore dem dey pay (N57,300) but now dey don tell dem to pay (N97,300).

Di suspension pf di new fee happun base on say di governor wan make e dey clear to everybodi say wen hin tok say student mata for him state na one of hin priority no be say na lie hin dey lie.

“As Nigerian students, we don come out to commend di efforts of di governor and as well as di Osun State Government on dis action wey dem take on top di mata, and dem dey implore di governor to do more”.

To read di full tori CLICKHERE

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *