fbpx
April 20, 2024

Pakistan ‘go need to agree’ to IMF conditions for bailout – Prime Minister

pakistan-imf-conditions-bailout

Pakistan Prime Minister Shehbaz Sharif on Friday yarn say di government go need to agree to IMF bailout conditions wey dey “beyond imagination”. An International Monetary Fund (IMF) delegation land for Pakistan on Tuesday after dia final attempt to tok about how dem go revive vital financial support wey don stop for months.

Also, di government don hold out against tax rises and subsidy slash wey di IMF demand. Dem dey fear di backlash ahead of elections wey go dey due in October.

According to di Sharif  for inside televised comment, he tok say hin no wan go into details but di thing be say dia economic challenge dey unimaginable. Di conditions wey dem go need to agree to with di  IMF dey beyond imagination. However, hin tok say Pakistan go need agree with di IMF conditions for bailout.

FOR MORE NEWS: Hong Kong wan giveaway free flights after covid isolation

Pakistan economy dey experience serious problem, as e dey attempts to service high levels of external debt, amid political chaos and a deteriorating security situation.

Di country central bank on Thursday yarn say dia foreign exchange reserves don drop again to $3.1 billion dollars. This na wetin analysts don tok say go dey enough for less than three weeks of imports.

On Wednesday, year-on-year inflation don rise  48-year high. Di matter kon make Pakistanis dey struggle to afford basic food items.

You fit go read more of di tori..READ MORE