fbpx
April 24, 2024

PDP don suspend National Chair, Ayu with immediate effect

Ayu-national-chair-dey-suspended-from-pdp

Di National Chairman of di Peoples Democratic Party, PDP, Iyorchia Ayu don dey suspended from di PDP  party.

Na di ward Executive of di party for Igyorov Ward of Gboko Local Government Area, LGA, of Benue state na hin effect di suspension of Ayu.

Addressing di media on Sunday, on behalf of Kashi Philip, di Ward Chairman, di Ward Secretary Mr. Vangeryina Dooyum explain say Dr. Ayu dey suspended by di Executive for claims of anti-party activities.

FOR MORE NEWS: Lagos election: LP ready to file suit against APC, Sanwo-Olu, PDP silent

Di Secretary yarn say hin make di decision to suspend di National Chairman after di leadership review hin conduct for di end of di just concluded general elections.

According to am, dem observe say, Dr. Iyorchia Ayu wey be di National Chairman of di PDP worked against di success of di party for Igyorov Council Ward.

Also, e dey for record say he fail to pay hin Annual Subscription Fees. Dis na as provided under Section 8 (9) of di constitution of di PDP 2017.

Further investigation reveal say hin no vote during di Governorship and State Assembly Elections on March 18, 2023.

As dem look di matter finish, dem pass Vote of No Confidence on Dr. Iyorchia Ayu. Also, Ayu dey suspended from PDP as a member of dia party with immediate effect.

In addition, di suspension take effect from March 24, 2023.”

You fit go read di tori…READ MORE