fbpx
March 29, 2024

“Na wetin I go do be dis if Tinubu invite me into hin government” – Peter Obi

peter-obi-and-tinubu-government

Presidential candidate of di Labour Party, Peter Obi, don tok say hin no go accept any offer to be part of Bola Tinubu Government of National Unity.

Tinubu, di president-elect and hin party, di All Progressives Congress (APC) bin enter court. Dis na after Obi carry di matter of di outcome of February 25 election go court.

Di camp of di APC candidate don take style yarn say di former Lagos Governor go form an all-inclusive government. Dat one na to carry all hin opponents along for hin government.

On top channels Television Sunrise Daily on Thursday, Obi answer questions. Dem ask am wetin hin go do if di APC call am to be member of Tinubu Government of National Unity.

FOR MORE NEWS: Bauchi police don give assurance of better security for gubernatorial elections

 Obi answer dem say hin dey challenge di process of di election and di declaration.

According to Peter Obi, di process of di election suppose dey right first before anybody or Tinubu fit tok of di Government of National Unity.

In addition, Obi tok say na after dem don get am right hin go tok about a government of national unity.

Also, when dem ask am whether or not he go accept di outcome if e no dey for hin favour, Obi yarn say hin go dey shocked if di court support Tinubu election.

Obi yarn say Issues about di election will dey sorted out for court. Hin yarn say he go dey shocked if dis Kontir continue with dat situation. E go stand say na corporate criminalised Kontri.

However, di former Anambra State governor yarn say hin believe say di judiciary go do di right thing.

You fit go read di full tori…READ MORE