fbpx
April 25, 2024

Nnewi prodigal brother – Peter Obi don reveal who leak hin conversation with Oyedepo

peter-obi-reveal-who-release-di-leaked-audio-with-Oyedepo

Valentine Obienyem, a media aide to di presidential candidate of di Labour Party (LP), Peter Obi, yarn say di leaked audio of hin principal conversation with di founder of Winners Chapel, Bishop David Oyedepo, dey edited out of context.

Also, Obienyem claim say ‘dia Nnewi prodigal brother’ dey responsible for di leak.

Inside di leaked audio clip,  e be like say Peter Obi dey advise Oyedepo make hin encourage Christians to vote for am.

“Daddy, I need you to speak to your people in the South-West and Kwara, the Christians in the South-West and Kwara. This is a religious war,” na wetin Obi tok inside di trending audio be dat.

FOR MORE NEWS: Leaked audio: I no campaign for any politician – Bishop Oyedepo

However, inside post on Facebook this Sunday, Obienyem yarn say di badly doctored conservation with Bishop Oyedepo released by dia Nnewi prodigal brother na di much wey dem don discovered so far.

Also, hin yarn say dem edit out di Muslim-Muslim ticket wey lead to di discussion. For dat part, Obi yarn say for society like ours, religious balancing na necessary consideration. Dis na because di muslim-muslim ticket don make Christians think say na religious war.

You fit go read di tori…READ MORE