fbpx
April 16, 2024

Fuel scarcity don hit Anambra as dealers increase price to N700

petrol-scarcity-for-anambra

Scarcity of petrol for Anambra State on Tuesday tie wrapper.

Di matter follow di announcement of di removal of fuel subsidy by President Bola Tinubu on Monday.

Tinubu during hin inaugural speech announce di end to fuel subsidy, hin yarn say e no dey realizable, and that money wey dem dey use for di subsidy go dey channeled into other areas.

On Tuesday, different motorists queue for some petrol stations wey opene business for Awka, while greater percentage of di fuel stations for di state no gree open.

 

FOR MORE NEWS: Dimitar Berbatov dey beg Nigerian striker make hin join Man Utd

 

Though announcement of sit-at-home exercise on Tuesday to commemorate Biafra Day bin come out but reporters no confirm whether di closure of fuel stations na because of di order, or because petrol no dey.

According to report, some of di fuel stations sell dia fuel for different prices.

While some stations sell for N400, plenty others put di price for N500. One source even yarn say for Ekwulobia, Aguata Local Government Area, some stations sell for N700 per litre.

You fit go read di tori of di Petrol scarcity for Anambra…READ MORE