fbpx
April 25, 2024

Viral video: Portable get 75-hour to report self to police

Portable-to-report-himself-to-police

Di Ogun State Police Command on Wednesday issue a 72-hour ultimatum for controversial singer, Habeeb Okikiola, wey dey known by hin stage name, Portable, to report himself to di nearest police station before Friday or prepare for arrest.

Dis matter come out for inside statement issue by di command spokesperson, Abimbola Oyeyemi.

Also, di Police Public Relations Officer, PPRO yarn say Portable dey informed to report himself to di police. In addition, he yarn say portable papa don dey beg di police, and dem promise to bring dia son go di station.

FOR MORE NEWS: Court cases no go stop hand over to Tinubu – FG

Series of video clips go viral on Tuesday. Di video show as di artiste dey  insult some officers of di Force for Ogun State, over claim of invasion.

Portable claim inside di viral video say one internet fraudster carry police come hin bar to arrest am and hin staff members “for no reason”.

Reacting to di viral video clips wey cause reactions on social media on Tuesday, di PPRO yarn say di police no want breakdown of law and order. So, hin arrest suppose take effect on Tuesday.

“His father has been begging but we have told him that if he (Portable) refuses to turn himself in between now and Friday, he will be arrested.” Na wetin di police man tok be dat.

You fit go read di tori…READ MORE