fbpx
March 28, 2024

Police don see di remains of missing girl body

police-don-see-di-remains-of-di-missing-girl-body

Di matter of di young woman from Illinois, USA don come out again. E don reach more than five years wey dem don dey look for di girl. Now,  Police don see di remains of missing girl body.

Di Police Detectives wey dey handle di matter yarn say na dental records dem use recognise di body of 22-year-old Cheyann Klus. This report come from CBS News on uesday, January 17.

Nov. 27, 2017, na hin be di last time wey person see Klus , and na for her house she bin dey. As she travel go Chicago, from that time nobody hear from her again.

Di tori about wetin cause her death neva come out, di details still dey on hold..

According to CBS, di investigation on Klus disappearance na joint effort of di Cook County Sheriff’ Office, di DuPage County Sheriff Office and di FBI.

FOR MORE NEWS: Mr. Macaroni yarn say Peter Obi go get hin vote

Klus’ sister, Mariah, confam di news of her sister identification for her Facebook post.

For di caption of di post, she yarn say dem plan to do private memorial service for Cheyann, but dem hope say pipo mind go dey at rest as she don announce say Police don see di remains of missing girl body, and dem go lay her to rest.

She tok say on behalf of her self and her family, dem dey ask for privacy so that dem go fit  grieve di loss of dia daughter, sister, aunt, and a human being.

You fit go read di full tori…READ MORE