fbpx
March 29, 2024

Married Police officer shoot girlfriend dead over suspicion of cheating

Twumasi-dey-under-arrest-for-killing-hin-girlfriend

An Inspector wey dey known as Ahmed Twumasi, wey dey suspected of killing hin girlfriend Victoria Daapa, also known as Maa Adwoa, dey under arrest by di Ghana Police Service.

Twumasi, wey dey married with children, dey accused of shooting di 27-year-old mother of one at close range on April 20th, 2023 for Adum, Kumasi. And, as person rush Daapa go  Komfo Anokye Teaching Hospital, na there dem declare her death upon arrival.

Di police issue press release on April 23rd, 2023 say dem arrest di Twumasi man for Sekyere near Effiduase for di Ashanti Region.

According to di statement, di police yarn say dem arrest di man dat evening.

FOR MORE NEWS: INEC ask police make dem look for Adamawa REC

Police officer arrest di Inspector Ahmed Twumasi, wey allegely shoot and kill a female adult, wey dem believe to be hin girlfriend.

Di shooting incident happen for Kumasi, for di Ashanti region, on Thursday, 20th April 2023. Also, di suspect wey dey on di run since di incident, finally enter police hand.

Na for Sekyere, near Effiduase for di Ashanti Region police catch am as a result of special Police operation.

Dis na operation wey di police launch following di shooting incident.

As e be now, di suspect Twumasi dey under arrest. And hin dey inside Police custody and dem go carry am go court to face justice.

You fit go read di tori…READ MORE