fbpx
April 24, 2024

Police Advise Nigerians to activate SIM lock, reveal criminals’ tactics

police-reveal-criminals-tactics-dey-advise-Nigerians-to-activate-sim-lock

Nigerians don receive advise from Police say make pipo activate lock on top dia Subscriber Identification Module SIM cards.

Public Relations Officer for Lagos, Benjamin Hundeyin give di advice inside Twitter post after di arrest of a syndicate.

Di spokesperson reveal say members of di syndicate dey pick phones, dump am after dem remove SIM cards.

With di stolen SIM cards, dem dey use bank USSD to buy airtime as e no dey require PIN.

FOR MORE NEWS: Peter Obi lament as Nasarawa women protest topless over election results

Hundeyin yarn say na so di criminals dey empty dia victim account one way or di other after dem don gain access.

“The only SIM cards the syndicate never succeeded with were ones with SIM lock. Nigerians Activate your SIM lock today,” na wetin di police tok be dat.

Sharp increase dey for unauthorised transfers and bills payments. Di matter don make banks issue reminders to customers on how to safeguard dia accounts.

You fit go read di tori…READ MORE