fbpx
April 16, 2024

Public universities must charge better school fees because of government magu magu — Ex LASU VC

Public-universities-must-charge-reasonable-school-fees

According to di Professor of Environmental Law, public universities must charge better school fees because di magu magu and way of government to education no go fit deliver good education.

Di immediate past Vice- Chancellor of Lagos State University, LASU, Professor Olarewaju Fagbohun yarn say di current tuition wey public varsities dey charge no fit guarantee dia sustainability.

As Fagbohun, dey deliver di 12th convocation lecture of Fountain University, Osogbo on Friday titled: The Nigerian University System: Between Public Hopes and Individual Expectations for the 21st Century, hin regret say plenty public varsities scatter because dem ignore wetin dem suppose do.

FOR MORE NEWS: JAMB Announce say Applicants Fit Pay For UTME With eNaira

Hin tok say as person no fit defend di insincerity of government, time  don reach, public universities must charge proper fees wey go allow dem remain sustainable.

Di starting point go be for government to first bring funds wey go stabilize the institutions. After that one, government go dey look into annual grantswey dey bench marked against di agreed performance indicators. Just like how World Bank Centers of Excellence dey do am.

“Government for different level need to look mechanisms for bursaries and scholarships wey go support indigent students. While Federal Government go need to revisit di loan scheme arrangement

You fit go read di full tori…READ MORE