fbpx
April 24, 2024

Rear door of Russian aircraft don shock pipo

rear-door-of Russian-aircraft

One viral video capture di terrifying moment when di rear door of Russian aircraft suddenly open just after e takeoff.

Di plane wey carry 25 people, including six crew members, take off from Magan for di Siberian region of Yakutia at minus 41°C, when di rear door opened. That incident make all di   passengers dey fear for dia lives. Who wan die?

Na one of di passengers share di clip wey don go viral now, di clip show di visible gap rear door of Russian aircraft for di plane.

Di door wey dem dey use load cargo and luggage dey always dey curtained off from di passengers for di back of di plane. But for di video, breeze just dey blow di curtain.

rear-door-of Russian-aircraft-passenger

Person wey record di video sef dey in shock,  hin don dey fear say na so hin go die.

FOR MORE NEWS: Bandit kpai Seven NSCDC officers, five others

Following di incident, di pilot no waste time make emergency landing for Magan, di Siberian region of Yakutsk. Good news be say dem report say all di passengers for di plane dey safe.

“Only di caps wey bin dey some pipo heads fly enter where dem no know.”

Another scary thing wey happen for there be say di breeze nealy blow one man comot for di plane, di man bin sit down for di rear of di plane.

Hin bin don comot hin seat belt. And na wetin make am almost fly comot for di plane.

You go like read di full tori…READ MORE