fbpx
March 28, 2024

Reason why Govt need to scrab EFCC – Agbakoba

Reason why Govt need to scrab EFCC – Agbakoba

Di Former President of the Nigerian Bar Association, Dr Olisa Agbakoba (SAN) on Thursday, don come out give some reasons why government need to scrap Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).

Hin tok say di commission like dis like dis dey operate outside di constitution.

Agbakoba yarn dis one for one news conference for Lagos.

According to wetin hin tok, hin tok say, since di creation of EFCC di National Assembly, no even get di power to interfere with dia activities.

Agbakoba tok say di Nigeria 1999 Constitution only provide police force for Nigeria, so since di Anti-graft agency no be a branch of the police force, hin no expect dem to perform dia functions.

Hin tok say EFCC go always remain a Federal establishment created by di national assembly, and under Section 4 of di 1999 Constitution, e dey stated say powers of government dey divided into two: wey bi di Federal and di state.

“So the question wey hin wan ask be say, since e bi like say na Federal government create EFCC so shey hin no fit prosecute state offences?

Hin tok say since “ di Supreme Court inside many of hin decisions base on federalism hin dey independent and if that na true, automatically di EFCC no get di right to go to the state and examine dia accounts.

Di former NBA president bi tok say: “ hin no believe say EFCC understand di law wey make dem stand as an organization, because as hin bi lawyer, hin dey a little bit confuse, as hin discover say di 1999 constitution no dey inline with dia mode of operation.

Agbakoba tok say “ na now hin con understand di reason why some pipol dey ask for restructuring for di country. Hin tok say pipol wey write di constitution do am for Nigeria to fail

Hin yarn dis one base on say, di Constitution on one hand, seems to authorise di EFCC to chook mouth inside state affairs while on di other hand, di same Constitution no allow ram.”