fbpx
April 24, 2024

Lagos governorship election: Sanwo-Olu don tok after victory

sanwo-olu-don-tok-after-victory

Governor Babajide Sanwo-Olu, wey win di Saturday governorship election for Lagos State, don express hin gratitude to di people of di State as dem vote for am.

Sanwo-Olu yarn say he dey honoured to dey re-elected as di Governor of Lagos State. Also, hin pledge to continue to work tirelessly to deliver better Lagos for all.

He drop dis update inside tweet via hin Twitter handle on Monday morning.

Di Independent National Electoral Commission, INEC, on Sunday night announce say Sanwo-Olu of di All Progressives Congress, APC say na hin win di Lagos governorship election.

FOR MORE NEWS: Adamawa Guber: INEC postpone collation of results after dem announcE 20 LGAs

Sanwo-Olu poll a total of 762,134 to defeat di first runner-up, Labour Party Gbadebo Rhodes-Vivour wey score 312,329 votes, while Abdulazeez Adeniran of di Peoples Democratic Party, PDP, poll 62,449 votes.

Reacting, Sanwo-Olu tweet: “Thank you Lagosians!

Also, hin thank di President of Nigeria, Muhammadu Buhari, GCFR, for hin commitment to leave a legacy of fairness and electoral outcomes wey reflect di will of di people.

Hin thank hin wife, Ibijoke, hin Deputy Governor, Dr. Kadri Obafemi Hamzat, and all fellow contestants for dia contributions. In addition, he yarn say Lagos don chose competence and experience, on dis march to true greatness.

Also, hin salute di ones wey no gree dey divided by hateful and hurtful ethnic profiling.

In addition, he yarn say as di Governor of Lagos, he go do everything wey dey hin power to ensure say genuine healing takes place. And dem go continue to run inclusive government for all di pipo of Lagos.

You fit go read di tori…READ MORE