fbpx
March 28, 2024

Saudi Arabia don bend marriage law for Ronaldo

Saudi Arabia don come out tok say dem dey readi to bend dia laws wey disallow non-married couples to dey stay for dia countri for Al-Nassr’s new player, Cristiano Ronaldo.

Di 37-year-old Portuguese forward don join Al-Nassr s hin become di highest paid footballer in December 2022 after hin terminate hin contract with Premier League side, Manchester United.

U FIT ALSO READ Transfer: Juventus don react to Cristiano Ronaldo move to Saudi Arabia Al Nassr

Saudi Arabia don permitte, Ronaldo and hin partner, Georgina Rodriguez will to dey live together without punishment.

Di five-time Ballon d’Or winner meet hin wife Rodriguez since 2016 when hin sign deal with Spanish giants, Real Madrid and both of dem don live together as husband and wife without marriage, and dey don get like five children.

According to tori pipol wey never marry no fit live together as couple base on say na greate abomination for Saudi Arabia.

According to report we hear say dem no go fit punish Ronaldo due to di kind persin wey hin be as one of di most marketable athletes in di world

“Dem tok say Although di laws still prohibit cohabitation without marriage contract, but base on say Ronaldo na foreigner na di reason why di authority don turn blind eye like say nothing happun.

Base on di report we hear say na like two separate Saudi lawyers, don chook mouth for dis matter talk say di appropriate authorities must make sure say dey no get dia self involved for Ronaldo situation.

” di report tok say di Saudi Arabian authorities, as of today, no wan interfere in cases like dis base on say di person wey dey involved na foreigners but still yet di law go still continue to prohibit cohabitation outside of marriage.

To read di full tori CLICKHERE