fbpx
April 19, 2024

7 pipo don kpai after di shootings for California farms, di suspect dey custody

7-pipo-don-kpai-for-two-california-farms

One worker wey dey vex don kill seven of hin coworkers, hin shoot another one give am injury for two farms wey dey di Northern California city of Half Bay for  U.S. on Monday afternoon, Jan. 23. Acoording to di report now, 7 pipo kpai after di shootings for di two California farms.

Di suspec be  67-year-old Chunli Zhao, after hin do all di things wey hin do, hin carry himself go meet di  authorities.

According to di report, Corpus yarn say Zhao wey be Half Moon Bay resident, commit all those act by himself. Also, hin dey “fully cooperate” with investigators after hin arrest.

 

Sheriff officials yarn say na four people hin gun down and one person get injury. Di other three victims kpai for another nursery. Police receive di  information  around 2:30 p.m on Jan. 23.

 

But e neve dey clear how di two locations dey tied together.  San Mateo County Board of Supervisors President Dave Pine tok say di suspect work for one of di businesses. Hin also call di suspect a “angry worker.”

 

FOR MORE NEWS: power outage interrupt APC rally for Bauchi State

 

More tori wey come out yarn say di victims be workers for di facilities. Some of di workers even live for di location with dia families.

San Mateo Sheriff Christina Corpus yarn say dem see Zhao for di parking lot of one sheriff’. Na for di substation hin surrende to deputies without incident.

 

Di shooting happen just two days after California experience another mass shooting wey make 11 pipo kpai inside ballroom for Monterey Park outside Los Angeles.

Na one 72-year-old Huu Can Tran na hin carry out di mass shooting on Saturday, Jan. 21. Di man later kill himself as police dey look for am.

Now, na 7 pipo don kpai after di shootings for di two California farms.

You fit go read di full tori…READ MORE