fbpx
April 23, 2024

Sina Rambo and hin wife Korth marriage don crash

0
Sina-Rambo-Adeleke

Marriage beetwin Davido’s cousin, Adesina Adeleke, popularly known as Sina Rambo, and hin wife, Korth, don crash, base on say di wife tok say her husband dey violent.

She bin yarn dis one ontop her Instagram stories on Monday, Korth accuse Sina Rambo and hin sister of violence, as she share videos, chats, and pictures to backup her claims.

U FIT ALSO READ Peggy Ovire don share secret ingredient wey make Frederick Leonard marry her.

She tok say like dis like dis di marriage beetwin di two of dem don over as she no fit succumb to abuse.

Korth also don call her husband, who bi son of di present Osun State Governor, Ademola Adeleke, for debt, as she don ask am to pay back di money wey hin owe her.

Sharing di receipt of di money wey she send give Sina Rambo him, Korth write say, “Later they will say Adeleke is my only achievement. Sina pay me my money you owe me from America and nigeria. Beg beg. How many people do you have to fight with over bills? Or until them jack you for neck again like it just happened.”

Showing di mark on her hand, Korth tok say na Sina sister inflict dat injury on her.

For one post she write say, “After having a caesarian section and him rushing me out the hospital because he couldn’t get no weed. I had COVID=19 in labour, after my CS.

“I left the hospital this n*gg* ain’t help with no chores! Three days after caesarean (section), you told me to cook rice for you. You can’t even make tea yourself! SMH!

“During pregnancy, I was turned into a nanny! Nine months pregnant, (I was) bending and cleaning house up and down because he can’t even pick up after himself. But truly, venting this now, I be mumu.na wetin write for her Instagram handle bi dat.

Sina and hin wife just welcome dia pikin, Lola, on May 2022.

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *