fbpx
April 24, 2024

Biafra: I go beg Tinubu to release Nnamdi Kanu – Soludo

soludo-vow-to-push-tinubu-to-release-Kanu

Governor Chukwuma Soludo of Anambra State don vow to push di incoming administration of di President-elect, Bola Tinubu, to release Nnamdi Kanu, leader of di Indigenous People of Biafra, IPOB.

Soludo yarn say if Buhari no gree release Kanu before May 29 when he hand over, he go appeal to Tinubu to take di action.

Since hin assume office, Soludo neva stop to beg Buhari say make hin release Kanu, wey dey locked up for di Department of State Services, DSS.

In April, Soludo bin write letter to Buhari to release Kanu.

 

FOR MORE NEWS: Release Nnamdi Kanu as parting gift to Ndigbo – Ibe dey beg Buhari

 

However, he express hope say hin previous letters wey hin take beg for Kanu release go dey copied to Tinubu.

Speaking on Channels Television’s Politics Today on Friday, Soludo  yarn say di di Attorney General dey copied in di letter and if President Muhammadu Buhari administration fail to take advantage of dis opportunity to rise above every other thing and be statesman, if di president fails to take advantage of that, dem go pursue di same thing with di incoming administration.

Di Governor still yarn say Kanu release go bring about sustainable peace and security for di Southeast.

You fit go read di tori as Soludo vow to push Tinubu to release Kanu…READ MORE