fbpx
April 25, 2024

Some people Yeye Me When My Son Change Address Go Heaven – Adeboye

Di General Overseer of di Redeemed Christian Church of God, Pastor Enoch Adeboye, talk say some people use am do yeye when he lost him son last year.

He talk dis on Tuesday night when him dey do di 70th Annual Convention of di church along, di Lagos-Ibadan Expressway.

Di programme wey Dem call di title, ‘Perfect Jubilee’ start on Monday, August 8th and go finish on Sunday, August 14th, 2022.

You fit like read: Bye-Bye To Tennis Playing – Serena Williams 

 

Adeboye talk say God carry am when him dey di saddest period of him life in May 2021 after him son die at the age of 42.

He talk say, when he dey di saddest period of him life, many questions dey come him mind and some people dey laugh him.

Him Kon add say one of him daughters text am say ,‘Daddy, let God carry you’. And that put an end to any problem” WE KNOW SAY YOU GO WAN READ DI TORI, OYA SHOOK EYES. READ MORE