fbpx
April 23, 2024

Stay in Nigeria don’t japa – Oyedepo warn Nigerian youths

Bishop David Oyedepo don come out warn Nigerian youths against ‘japa’ Syndrom wey dey circulate di mind of di youth for di countri (leaving Nigeria for greener pastures).

Di founder of di Living Faith Church wey pipol also known as Winners Chapel yarn dis one with News Agency of Nigeria (NAN) on Saturday.

U FIT ALSO READ Lawyers go pay N1m to apply for SAN

Oyedepo tok say hin dey advice nigerian government to massively invest in citizens of di countri to restore all di good wey don turn bad to di countri in order to move di countri forward.

Hin tok say di human capital development remains the most viable and stable stock of any nation to survive.

Oyedepo tok say Education requires more investment being base on say na education bi di bedrock wey fit make make any countri sustain dia national development,

Oyedepo still tok say if di government fit enable good environment for di youths, e go reduce di number of pipol wey dey leave di countri.

Hin tok say relocating to anoda pipol countri no bi di best option to survive for life, sake of say many youths don dey stranded for many foreign countries and dey refuse to return to dia fathers land becos of shame.

Hin tok say,“Parents need to reorientate dia children. give dem good reason why dey all need to stay in Nigeria and rebuild dis great countri.

Bishop tok say,“Everyone get hin own part to play in order to recover dis nation call Nigeria”.

To read di full tori CLICKHERE