fbpx
March 28, 2024

Tinubu don cancel 71st birthday celebration

tinubu-cancel-birthday-celebration

Nigeria President-elect, Bola Tinubu, don cancel di annual colloquium to mark hin birthday dis year.

Instead, Tinubu wey go turn 71 years on Wednesday, choose special prayers and thanksgiving service.

Di former Lagos Governor dey always mark hin birthday celebrations with a colloquium, but dis time, Tinubu don cancel di annual colloquium.

Inside statement on Monday, a media aide to Tinubu, Tunde Rahman, yarn say dem go hold prayers for Lagos and other parts of di Kontri

FOR MORE NEWS: Nancy Isime don share why she no enjoy kissing scenes

Also, dem go hold di special prayers for di central mosques for each of di five divisions for di state.

“Also to receive prayers among others na President Muhammadu Buhari and First Lady Aisha Buhari, President-elect Tinubu, and hin wife, senator Oluremi Tinubu, Vice-President-elect, senator Kashim Shettima, and Hajia Nana Shettima, Governor Babajide Sanwo-Olu, other state governors as well as members of national and state houses of assembly,” na wetin part of di statement read be dat.

You fit go read di tori…READ MORE