fbpx
April 25, 2024

“I call on Nigerians to pray and support our president-elect” — Tinubu daughter

Tinubu-Ojo-appeal-to-Nigerians

Mrs. Folashade Tinubu-Ojo, daughter of President-elect Bola Tinubu, don appeal to Nigerians make dem extend dia support and prayers to her father so dat hin go fit govern di Kontri well.

She tok am during di 28th annual Ramadan Lecture and Special Prayer for di Nation wey dey organized by di Ansar-ud-Deen Society of Nigeria (ADSN) for Abuja on Saturday.

Di theme of di event, ‘Ramadan: Islam and Good Governance: di Role of Muslims’, bin hold for di ADSN Central Mosque in Maitama.

FOR MORE NEWS: Former Chief of General Staff for Nigeria Oladipo Diya don kpai

As Tinubu-Ojo appeal Nigerians, she stress say her papa success dey important for di well-being of Nigerians.

“I call on Nigerians to pray and support our president-elect to make him succeed in making Nigeria the best for all. He cannot do it alone and Nigerians must support him, even after the elections,” Tinubu’s daughter said.

She add say, pipo wey dey di helm of affairs must help di needy and those also nwey no dey leadership positions must also help di needy to engender societal and national development.”

You fit go read di tori…READ MORE