fbpx
March 19, 2024

Tinubu ‘hale and hearty, traveled abroad to rest’ – Keyamo

tinubu-dey-hale-and-hearty-keyamo-don-tok

Di Minister of State for Labour and Employment, Festus Keyamo don declare say di President-elect, Bola Tinubu dey hale and hearty.

Keyamo make di statement as hin mention say Tinubu travel abroad go rest.

He dey react to di reports wey yarn say Tinubu dey sick and dem rush am go abroad for medical treatment.

According to di report, dem rush di President-elect go Paris for urgent medical attention.

FOR MORE NEWS: 2023 elections: APC don suspend SGF Boss Mustapha

However, Keyamo yarn say pipo wey still dey nurse dia wounds from di defeat of di presidential election na hin dey behind di rumour.

Inside statement wey sound rude to some pipo, Keyamo write: “Please help us tell those flying the news around that the election has ended.

Hin tok say those pipo dey campaign after election. And hin tell dem say make dem leave Asiwaju. Also, hin tok say Asiwaju deserves some rest after di election.”

Also, Keyamo follow reveal say hin no fit confirm if Tinubu travel abroad for vacation.

“I cannot confirm. But all I can tell you is that Asiwaju Tinubu dey hale and hearty,” Na wetin hin tok be dat.

You fit go read full tori…READ MORE