fbpx
April 16, 2024

Tinubu go decide subsidy removal date after inauguration

tinubu-go-decide-subsidy-removal

Di All Progressives Congress Presidential Campaign Council yarn say di incoming administration of Asiwaju Bola Tinubu na hin go decide di date for fuel subsidy removal.

Though di regime of di President, Major General Muhammadu Buhari (retd.) yarn say di subsidy policy go end by June when di budget for di initiative go lapse, di Chief Spokesperson for di All Progressives Congress PCC, Festus Keyamo, on Sunday, mention say di next government go determine di terminal date for di subsidy regime

Pipo get concern over di planned removal of subsidy with marketers and other petroleum stakeholders wey tok say di development fit push fuel prices to N750 per litre.

FOR MORE NEWS: Market leaders warn Lagos traders against fixing random prices

Despite di worry over di issue, di Petroleum and Natural Gas Senior Staff Association of Nigeria last week call for subsidy removal.

PENGASSAN President, Festus Osifo, wey tok dis one for di National Executive Council meeting of di association for Abuja, beg di government say make dem ensure di speedy rehabilitation of Nigeria refineries. Hin stress say dat one go help ease di hardship wey fit arise from di halt of fuel subsidy.

But di Nigeria Labour Congress don vow to resist di plan, hin insist say di refineries must dey functional before dem fit tamper with di subsidy.

Also, di Nigerian National Petroleum Company Limited yarn say di Kontri dey spend over N400bn monthly on petroleum subsidy.

You fit go read di tori on Tinubu wey go decide subsidy removal….READ MORE