fbpx
March 19, 2024

Tinubu no get di capacity to run Nigeria – Bode George

tinubu-no-fit-run-nigeria-Bode-George-hint-relocation

Bode George, a former Deputy National Chairman of Peoples Democratic Party, PDP, on Monday drop hint on di possibility of hin relocation to any Kontri of hin choice. Di update come following di victory of Bola Tinubu, for di just concluded presidential election.

Di PDP chieftain wey be major critic of Tinubu, di presidential candidate of di ruling All Progressives Congress, APC,for di February 25 poll, tok dis matter when dem feature am on Channels TV program.

Before di emergence of Tinubu as president-elect, Bode George don tok say hin wan go on exile if di former Lagos governor become President Muhammadu Buhari successor.

FOR MORE NEWS: Tinubu don cancel 71st birthday celebration

Speaking with Channels after di Independent National Electoral Commission, INEC, declare Tinubu President-elect, di former PDP chairman tok wetin dey hin mind. Bode George hint relocation as hin tok say na hin right to live anywhere for di world.

“I didn’t hide my feelings: I said if this fellow (Tinubu) becomes the President, I will lose my interest politically.

“I have the right as a Nigerian to live anywhere I want. And I am saying it publicly that I am ready to retire from partisan politics. This is my own personal conviction that they don’t have the capacity, the ability to run this nation.” Na wetin hin tok be dat.

You fit go read di tori…READ MORE