fbpx
April 25, 2024

Transfer: Juventus don react to Cristiano Ronaldo move to Saudi Arabia Al Nassr

Ronaldo-transfer-Juventus-react-

Italian giants Juventus don react to Cristiano Ronaldo move to di super rich Saudi Arabian league.

Di Old Lady wish Ronaldo, wey spend three seasons for Turin, well for di next chapter of hin career.

Ronaldo joined Al Nassr on December 30 on a free transfer and dem unveil am on Tuesday, four days after he sign a two-and-a-half-year deal.

Ronaldo bin dey unveiled to Saudi Arabian football lovers for dia Mrsool Park Stadium in front of capacity crowd.

FOR MORE NEWS: Ronaldo vs Ighalo: Who go be Saudi goals king?

Ronaldo enter di pitch with Al-Nassr yellow-and-blue home kit wey hin wear. Di kit resemble Juventus’ third kit for di 2021-22 season.

Ronaldo wear di kit for hin final game for di Bianconeri for di 2-2 draw with Udinese for August 2021.

And di Italian giants, via dia TikTok handle, spot di resemblance and dem wish di football icon all di best.

You go like go read di full tori…READ MORE