fbpx
March 29, 2024

Tribunal give Obi 21 days for hearing on election petition

tribunal-give-obi-21-days-hearing

Di leadership of di Labour Party and dia presidential candidate, Peter Obi, don collect window period of 21 days for di elections petition tribunal to fix date for di hearing of hin case.

Dis update dey disclosed by di Chief Spokesman of di Obi-Datti Presidential Campaign Council, Dr Yunusa Tanko, during exclusive interview.

Also, di development come in di wake of a report say Obi bin formally filed di petition to protest di outcome of di February 25 poll to di tribunal on Tuesday.

As Tanko dey happy about Obi 21 days hearing, hin yarn say di former governor of Anambra State don start di process of reclaim di pipo mandate for court.

FOR MORE NEWS: I don finish my earthly ministry, and I go soon d!e — Prophet Odumeje announce

He yarn say di tribunal don give 21 days of response. So na only after dat time dem go fit fix date for di hearing.

Also, di (duration) na legal procedure from di tribunal. And dem don share a copy of di petition to keep di media updated of development.

Obi petition dey come four weeks after di controversial presidential and National assembly elections wey produce di president-elect, Asiwaju Bola Tinubu.

Although Tanko no reveal why e take hin principal long to file di petition. Person within di party disclose say di former governor of Anambra State wan properly collate materials to back up hin claim of massive rigging, voters intimidation and corruption allegation against di electoral umpire. 

You fit go read di tori…READ MORE