fbpx
March 28, 2024

Dowden don become UK deputy PM

uk-name-dowden-prime-minister

Di British government UK don name Oliver Dowden as di Kontri deputy prime minister on Friday.

He replace Dominic Raab wey resign on Friday following a case of bullying staff during hin time for government.

Also, di punch report say Raab, wey also quit as justice secretary, tok for hin resignation letter say hin feel “duty bound to accept di outcome of di inquiry” but he tok say hin “dismiss all but two of di claims wey dey levelled against am”.

FOR MORE NEWS: 38 days to go, Buhari dey beg for forgiveness

Sunak appointment of Dowden as deputy prime minister cement hin reputation for government as di prime minister right-hand man. Also, dis na after a stint for di Cabinet Office where hin dey responsible for coordinating di government response to winter strikes.

Dowden na culture, media and sport secretary for 18 months for Boris Johnson government. Na during dat time hin provide emergency funding for di arts during di pandemic and also ban Huawei from UK 5G networks. Dis na wetin di Guardian UK report.

Also, lawmaker Alex Chalk dey appointed as new justice minister, a position wey dey previously held by Raab.

You fit go read di tori as UK name Dowden prime minister…READ MORE