fbpx
March 28, 2024

UNILORIN no go stop academic activities over elections -VC

unilorin-academic-no-go-top-because-of-elections-vc

Di Vice-Chancellor of University of Ilorin, Professor Wahab Egbewole SAN, yarn say di institution no go shut down dia academic activities during di forthcoming general elections. A di matter dey now, di VC of UNILORIN don stand dia ground say dem no go stop academic activities over elections.

However, he make am clear say dem no go stop students and staff from voting. Also, di university don design programme where students fit attend virtual class, and dem fit vote for anywhere wey dem dey.

“We no go suspend our lecturing for voting, Unilorin dey digitized,” Na wetin hin tok be that.

Also, di VC yarn say di management of di university UNILORIN  don design di school academic programmes to make sure say all lost academic calendars to di 8 months strike by di Academic Staff Union of Universities dey recovered, latest by October while new academic session go start in August 2023. Na di reason why hin yarn say UNILORIN  no go stop academic activities over elections.

Egbewole make drop all this updates as hin dey answer questions from journalists during hin maiden media parley on Wednesday.

FOR MORE NEWS: UNIABUJA Internship Programme, 500 Students Don Show Interest

 

Hin yarn say for di last 100 days of hin assumption as vice-chancellor, di university under hin regime don attract N500 TETFund grants for hostel accommodation for students, another N400 million for broadband from di ministry of communication and N200 million grant for ICT.

Similarly, di VC yarn say some staff of di school don follow attracted N100 million grants through dia research works for di university.

Egbewole even announce plans by di university under hin administration to complete dia long-initiated Tanke–UNILORIN rail transportation system. This na to ease transport wahala wey students dey face.

He emphasize on di fact say di university “dey engage di Embassy of China” to handle project. According to am, na di project wey hin start about 10- 15 years ago.

In addition, di VC yarn say di university under hin administration dey plan “electric bus transportation system for micro level” so that studentsgo enjoy smooth ride.

You fit go read di full tori…READ MORE