fbpx
April 25, 2024

US don condemn voter suppression for Lagos, ready to sanction perpetrators

us-condemn-voter-suppression-for-lagos

Di United States Mission for Nigeria don react to di disturbing events wey happen during gubernatorial and state assembly elections on March 18. US don condemn voter suppression for Lagos, and dem ready to sanction perpetrators.

A statement on Tuesday express deep concern by violent voter intimidation and suppression wey happen for Lagos, Kano and other states.

Dem mention say members of dia diplomatic mission observe di elections for Lagos and other places and dem witnessed some of di incidents first-hand.

As US condemn voter suppression for Lagos, di American embassy yarn say di use of ethnically charged rhetoric before, during, and after di gubernatorial election for Lagos na hin worry dem pass.

Also, di Mission hail political actors, religious and community leaders, youth, and citizens wey tok against violence and inflammatory language, and dia commitment to di democratic process.

FOR MORE NEWS: 2023 elections: Protesters call for interim government, arrest of INEC chairman

Di U.S. charge Nigerian authorities say make dem hold accountable and bring to justice anybody wey dem see say na hin dey give order or wey dey carry out order to intimidate voters and suppress voting during di election process.

In addition, di government yarn say dem go consider all available actions, including additional visa restrictions, on individuals wey dey believed to dey responsible for undermining di elections.

Di U.S. remember say dem join other international observers to advise di Independent National Electoral Commission (INEC) say make dem improve voting processes and technical elements wey happen during di February 25 poll.

You fit go read di full tori…READ MORE