fbpx
April 23, 2024

Rivers Guber: Wike na drunk, hin dey spend N50m every week on alcohol – Amaechi

wike-dey-spend-n50m-on-alcohol

Amaechi-Wike

Former Governor of Rivers State, Chibuike Amaechi don describe di State Governor, Nyesom Wike as a drunk, according to Amaechi, Wike dey spend N50 million on alcohol every week.

Hin insist say di Governor dey plan a third-term for office through di pipo wey hin dey pay and governorship candidate of di Peoples Democratic Party, PDP, for di state, Siminalayi Fubara.

Amaechi yarn dis oin on Tuesday when he campaign for di All Progressives Congress, APC, governorship candidate for di state, Tonye Cole for Ogba-Egbema-Ndoni Local Government Area ahead of March 18, 2023, governorship and State Houses of Assembly elections.

Di former governor dey lament say Wike dey spend N50 million alcohol, and di State funds wey don waste on alcohol alone by di governor dey enough to start and complete projects wey go dey of huge benefit to di people of di state.

Also, Amaechi yarn say hin build primary schools during hin time as governor with almost di equivalent of wetin Wike dey spend on alcohol in two weeks.

Amaechi claim say hin get all those details directly from Wike alcohol supplier. In addition to dat, Amaechi tok say di pipo of di state dey celebrate am today. Dis na because of di good works wey hin do for di state.

You fit go read di full tori…READ MORE