fbpx
April 25, 2024

Presidential election: I advise Atiku, Tinubu make dem step down for younger generation – Wole Soyinka

wole-soyinka-reveal-hin-advise

Nobel laureate, Prof Wole Soyinka don reveal how hin advise di 2023 Presidential candidate of di Peoples Democratic Party, PDP, Atiku Abubakar, and hin All Progressives Congress, APC, counterpart, Bola Ahmed Tinubu, say make dem step down for di younger generation.

Soyinka drop dis update as hin reveal hin advise when dem feature am an top di Arise Television morning show on Wednesday.

Remember say na Tinubu win di 2023 presidential election, as hin beat hin close rivals Atiku, and Labour Party Peter Obi.

Atiku and Obi since don go courts to challenge Tinubu victory.

“When Atiku came to my office in Ikeja, he came with Gbenga Daniel, my former governor. I said to him listen is about the time you people left the stage. Why don’t you just go away? We need an infusion of fresh blood into the system,” Na wetin Soyinka tok be dat.

FOR MORE NEWS: Vice president-elect, Kashim Shettima don react as hin supporters die inside fatal accident

According to Wole Soyinka, hin yarn say hin nio fit support Atiku because hin think say Atiku generation need to quit. Also, hin yarn say no be only Atiku hin tell, hin tell di president-elect Tinubu di same thing.

In addition, hin tell dem say make dem look for somebody wey be brilliant individual and make dem use dia influence to catapult dat person to power. And this country go see massive transformation.

“We spoke for about one and a half hours, and then Bola Tinubu said no. He said there were still things he could contribute,” Na wetin Soyinka add be dat.

You fit go read di tori…READ MORE