fbpx
March 29, 2024

Women protest topless at US Embassy in anger over 2023 election

women-protest-for-us-embassy

Women of di Free Nigeria Movement stage protest for di US Embassy for Abuja over claim of fraud during di 2023 presidential election.

Some of di women bin dey partially topless while others wear cloth as dem go protest for US Embassy to demonstrate dia resentments while pleading for action.

Di protesters do placards and dem demand say make di US Government impose visa ban on those responsible for instigating violence during di election.

FOR MORE NEWS: Supplementary elections dey set for April 15 — INEC

You go remember say Bola Ahmed Tinubu of di APC bin dey declare as di winner of di presidential election on February 25 by di Independent National Electoral Commission (INEC). Despite claims of electoral fraud and rigging for various parts of di Kontri.

Di closest challengers, Atiku Abubakar of the PDP and Peter Obi of di Labour Party, don file petitions with di Election Tribunal to pursue dia grievances.