fbpx
March 19, 2024

Actor, Yul Edochie don lose hin first son, Kambilichukwu

yul-edochie-lose-first-son

According to reports, popular Nollywood actor, Yul Edochie, don lose his first son with hin first wife, May, Kambilichukwu Edochie.

Although, di details wey surround di death of Yul Edochie son neva clear. However, according to reports, Kambilichukwu slump as hin dey play football with hin friends.

A family member wey confirm di news to Vanguard yarn say di 16-year-old bin read throughout di night on Tuesday in preparation for hin exams on Wednesday.

After hin examination, na so he join friends to play football.

As hin dey play di ball, na so he slump and hin develop seizure. Na immediately dem rush am go Mother and Child Hospital, where dem confirm say hin don kpai.

FOR MORE NEWS: BBNaija star Khloe don react to claim of leaked bedroom tape

“After his exam in school, he joined his mates to play football and he developed a seizure and was rushed to Mother and Child Hospital. All efforts by the doctors to resuscitate him proved abortive,” Na wetin di person tok be dat.

Yul Edochie and hin wife May neva make any public statements about di reported loss of dia son at di time of dis writing.

However, fans and colleagues don take to social media to express dia condolences and offer words of comfort to di actor and hin family.

Kambilichukwu turn 16 in January 2023 and hin parents take to social media to celebrate dia pikin.

You fit go read di tori of Yul Edochie wey lose hin first son…READ MORE