fbpx
March 19, 2024

Yul Edochie don report hin son death to police, investigation don start

yul-edochie-report-hin-son-death-yul-edochie-report-hin-son-death

Famous Nollywood actor, Yul Edochie don report di death of hin son, Kambilichukwu Edochie to di Lagos State Police Command.

Di state Police Public Relations Officer, SP Benjamin Hundeyin confirm di development in a chat with reporters on Friday morning.

Kambilichukwu die on Thursday morning after hin develop seizure and dem rush am go di Mother and Child Hospital for Lagos.

FOR MORE NEWS: Actor, Yul Edochie don lose hin first son, Kambilichukwu

E dey gathered say contrary to reports wey yarn say di 16-year-old boy die for di presence of hin mama and papa, e turn out say na for school di boy die.

According to di police, dem go forward di matter go di State Criminal Investigation Department on Friday [today] for investigation, and dis one dey happen after Yul Edochie report hin son death.

You fit go read di tori…READ MORE