fbpx
April 26, 2024

Shey na true say Davido and Chioma don do secret wedding….

0

Music Star Davido and Chioma wey lost dia son Ifeanyi for the tragic accident wey happen for their mansion wey dey Banana Island Lagos few weeks ago..don dey trend for social media on top another matter…. Rumoor dey fly up and down say Davido and Chioma don do secret wedding.

According to report, we gather say true true Davido and Chioma don do traditional wedding for secret a week ago.

You go like read : Buhari don enter Abuja from London

Some aproko people don shook mouth say wetin make dem do the secret wedding nah because of Igbo tradition, so that Davido go fit bury his son as Adeleke. Dem yarn say, the Igbo tradition no gree say may person bury pikin  wey you never pay bride price on top the Mama to the family.

Another set of aproko people still don yarn say, na Davido Papa talk say may two of dem do the traditional wedding sharp sharp, without any delay, especially as the fire of love between the two still dey strong Zuma rock.

We hear say the traditional wedding take place for Davido’s house and nah only few family members gather dey the ceremony as dem pay full bride price on Chioma.

You go like read more about the tori…..I dey here

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *