fbpx
November 16, 2024

2023 guber: Obidients movement don join YPP for Akwa Ibom

obidients-movement-join-ypp-for-akwa-ibom

Di Peter Obi-Yusuf Datti Campaign movement wey dey known as ‘Obidients’ for Akwa Ibom State on Saturday, March 4, collapse dia structure to di Young Progressives Party, YPP for di coming March 11 governorship election for di state.

Dis update dey contained inside press statement wey dey signed by Otoabasi Asuquo and Engr Otoabasi Ntiah, respectively di Convener and Coordinator of di movement for di state. Na during di formal declaration of support for di YPP guber candidate, na hin Senator Bassey Akpan read di statement for Uyo, di state capital.

However, di team dismiss di insinuation say di Obi-Datti / Obidients movement na for di Labour Party as dem join YPP for Akwa-Ibom state. Hin yarn say  “As Obidients, dem no dey controlled by political party policies or ideologies. Butr, dem dey look out for candidates with good character, capacity, competence and compassion. Also, dem chose to promote di best presidential candidate, that of di Labour Party, HE Peter Obi, because dem see say hin get di solutions to Nigeria problems.

FOR MORE NEWS: Labour don threaten to shut down seaports over salary review

As sem dey pray for victory and safety, Chief Orie advise di pipo make dem no dey discouraged by di experience of February 25, but make dem make bold statement with dia PVCs.

Receiving the endorsement, Senator Akpan thank di ‘Obidients’ for di show of love and confidence wey dem show am and, he promise say he no go let them down.

Also, hin promise say hin go create an enabling environment for the traders wey be majorly Igbos to do dia business without overbearing taxation.

You fit go read di full tori…READ MORE