fbpx
April 27, 2024

Taraba: Malle win APC primary for Jalingo-Yorro-Zing federal constituency bye-election.

malle-show-face-for-bye-election

Aminu Ibrahim Malle don show face as di All Progressives Congress, APC, candidate for di upcoming bye-election for Jalingo-Yorro-Zing Federal Constituency for Taraba State.

Also, Di party primary wey happun for Jolly Nyame Stadium for Jalingo over di weekend, see Malle carry 41 votes. Hin votes pass im competitors like Mohammed Alkali, Abdulmumini Hamza, and Bilyaminu Umar.

Di bye-election come up afta di untimely death of Ismaila Maihanci. And na im win di seat under di Peoples Democratic Party, PDP. Dat one happen for di 2023 general election.

Chairman of di Electoral Committee, Lawan Isma’ila, announce Malle as di winner and hail di election say e dey fair.

E beg di contenders wey no win make dem join hand with di person wey carry di flag to knack PDP for di election wey dey set for February 3rd.

 

FOR MORE NEWS: N585m scandal: Sack Betta Edu, save Nigeria democracy – Adeyanju tell Tinubu.

 

State Chairman of di APC, Barrister Ibrahim Tukur El-Sudi, talk say e get faith say di party get power to win for di poll.

Also, e call on di election referee make e ensure say all candidates and parties dey operate on di same level ground.

APC Publicity Secretary for di State, Aaron Artimas, hail di delegates for how dem behave maturely during di primary.

Artimas talk say di primary election na di Electoral Committee wey di National Secretariat choose do am. Also, di party provide conducive environment wey no get any kasala.

You fit go read di tori as Malle show face for upcoming bye-election …READ MORE