fbpx
April 27, 2024

Killing of soldiers: Ughelli King don break silence

soldiers-die-for-delta-community

Dem talk say 16 soldiers and officers die for di Delta community on Thursday. The Ovie of Ewu-Urhobo Kingdom for Delta State, HRM Clement O. Ikolo, don yan about di wahala wey happen for im kingdom.

Di victims include di commanding officer, two majors, one captain, and 12 soldiers.

Also, dem deploy di troops to restore order between two communities wey dey fight: Okuama and Okoloba communities for Delta State, but na so dem kill dem.

The Okuama coastal community wey di killing happun burn dis weekend.

We no sabi if na di military burn di houses, but some gun boats wey dem suspect say belong to di navy, dey behind di houses wey dey burn for di coastal community.

Di king talk say e hear say dem don settle di matter between di communities.

 

FOR MORE NEWS: “I no be Afrobeat artist” – Wizkid dey vex, e warn bloggers make dem no post him new album.

 

E talk say: “Wetin happun na very sad tori. First of all, make I yan clear say when dis whole wahala start between my community, Okuama and Okoloba, I dey for UK for dat time; early dis year.

“I contact di government about di crisis and dem tell me say dem don invite both parties to settle di matter and dem say e don settle. Na wetin I sabi be dat.

“Na very sad time for our kingdom. Dis military men na pipo wey suppose dey respected well-well. Dem dey there to protect us from pipo wey wan invade or commit big crime.

“E pain me soteh say di same pipo wey suppose protect us go die for di process. E dey break my heart and I condemn am totori. May their souls and di souls of all di faithful wey don die, through di mercy of God, rest in peace,” e talk.

You fit go read more on di tori wey talk say Soldiers die for Delta community…READ MORE