fbpx
November 16, 2024

March 11 polls: Confusion dey everywhere as INEC postpone state elections

inec-don-postpone-state-elections

Plenty pipo don believe say di Independent National Electoral Commission, INEC, don postpone di governorship and State Assembly elections.

Di exercise wey dey planned for Saturday March 11 don move by one week go – Saturday March 18 according to reports.

In addition, di National Commissioner for Information, Festus Okoye no gree take calls from reporters as at 10:00pm Wednesday.

FOR MORE NEWS: Guber election: God forbid – Aisha Yesufu disagree with Peter Obi over governorship candidate

Also, di electoral umpire dey accused of inadequate preparedness for di 2023 general elections, pipo feel say INEC no prepare well and na wetin make dem postpone di state elections.

Earlier today, di Court of Appeal grant di prayer by INEC to reconfigure the Bimodal Voter Accreditation System, BVAS, ahead of di state polls. Dis na as dem tok say e dey necessary before state elections go fit hold.

According to one  source within di Labour Party, LP, hin yarn say no cause for alarm over the rejection of Peter Obi appeal against INEC request.

Hin tok say court don grant dem access to inspect BVAS. And dem don backup all di contents, so problem no dey for now,” Na wetin di insider tok be dat.

You fit go read di full tori…READ MORE