Gridlock: FG Don Remove Barricades On Lagos-Ibadan Expressway
Di federal government on Thursday remove barriers for di construction area on Lagos-Ibadan Expressway so dat vehicles go get free movement ahead of Easter
Remember say di traffic dey always choke around di Kara Bridge outbound Lagos, and e dey cause daily traffic wahala for travelers.
Di gridlock don worse pass as e dey before, and di matter don make di usual gridlock worse in and around Lagos metropolis.
According to reports, plenty travelers bin wey stranded on Thursday inside di gridlock wey extend to Alapere as early as 10:30 am.
FOR MORE NEWS: “Wetin happen for Lagos na war, no be election – LP Gbadebo Rhodes-Vivour
Di Federal Controller of Works for Lagos State, Mr Umar Bakare, yarn say dem di diversion points wey dey for some sections of di expressway due to ongoing construction na hin dem don clear.
He yarn say all di crash barriers around OPIC for di Ibadan-bound carriageway don comot and now, di area dey open to enable free flow of traffic.
In addition, hin yarn say dem don create slip road around di Kara Bridge section on di same side to ensure smooth travels out of Lagos.
You fit go read di tori, Federal government don remove di barriers for Lagos-Ibadan Expressway…READ MORE