Buhari react to death of Bola Ajibola
President Muhammadu Buhari don react to di news of di death of a one-time Attorney General and Minister of Justice, Prince Bola Ajibola, SAN.
Buhari, inside message wey dey signed by Femi Adesina, hin spokesperson, sympathize with di family of di renowned jurist. Hin pass on at 89.
Also, hin commiserate with di legal community for Nigeria and worldwide.
And hin note say di lawyer use hin God-given knowledge, intellect and talent to advocate for justice, fairness and equity for all hin undertakings within and outside Nigeria.
Buhari yarn say di late Ajibola, as hin rise to di pinnacle of hin career, hin take hin brilliance in law practice to di International Court of Justice for The Hague. And hin serve between 1991 and 1994.
Also, before Ajibola die, hin be di Nigerian High Commissioner to di United Kingdom from 1999 to 2002.
According to Buhari, Ajibola contribute well well to di development of Nigeria legal system. Dis na as hin serve as di Attorney General and Minister of Justice at a critical period for di history of di nation.
In addition, Buhari message follow dey extended to di government and pipo of Ogun State, Ajibola home state.
You fit go read di tori as Buhari react to Ajibola death…READ MORE