fbpx
November 16, 2024

“End time parents” Reactions as heavily pregnant lady posts video of herself smoking weed with boyfriend

pregnant-nigerian-lady-smoke-weed

One pregnant Nigerian lady don spark mixed reactions online with video of her as she dey smoke weed even as person wey dey her condition.

Di Pregnant Nigerian lady show off herself as she dey smoke weed marijuana with her boyfriend inside dia room as she show off her baby bump.

Also, di young woman and her man, wey she refer to as her husband, hold di weed for dia hand and dem dey drag di smoke as dem put on a show for social media users.

In addition, di couple bin dey vibe and singing along to Joeboy songs. And di heavily pregnant woman no even do like person wey dey bothered about di effect wey di drug go get on her unborn baby.

However, Netizens condemn her for exposing her child to untold health challenges even before birth.

FOR MORE NEWS: WAEC scratch card claim say Sanwo-Olu submit fake GCE result to INEC, Jandor don react

Reacting to di post…

bishopfranko; Dem go born to his or her royal HIGHNESS

ameerahsweetness; So after they have the baby and the baby develops complications they will now cry to Nigerians to help them una dey do yourself this is rubbish

ayo_bayo21; Later una go say pkin get mental problem… May God have mercy on the child. Amen

susan.ehis; As funny and bad as it looks, that baby would be perfectly healthy

seunpizzle; They are about to give birth to igbolabi

happiokos_comedy; See people wey wan be parents

iam_panshaq; Na why dem go born pikin e go resemble Sango

eseoghene954; Na wetin the baby say make she take, the Werey want high, he/she Dey go through a lot for womb.

You fit go read di tori…READ MORE