fbpx
November 16, 2024

Arewa Elders Caution Obi, Datti-Ahmed Against Provocative Utterances

arewa-elders-political-concern

Arewa Elders for di convention wey dey organised by di Gamji heritage don tok say di events wey unfold within di Nigerian political landscape calls for concern.

Also, hin stress say any attempt by anybody, group of pipo or organisation to truncate di democracy under any guise go dey resisted.

Dis na just as di elders warn political actors, especially di presidential candidate of di Labour Party (LP), Mr Peter Obi and hin running mate Senator Datti Ahmed say make dem avoid  some tok wey fit trigger repeat of 1966 coup wey lead to killings of regional leaders.

In addition, di Arewa elders yarn ay e dey for record say Obi allegedly engage in a divisive ethno-religious campaign during di 2023 elections.

FOR MORE NEWS: We don lose 130 Persons In 10 Days – Ortom

Di pipo wey dey in attendance for di convention na Gamji Heritage, Jamiyyar Matan Arewa (JMA)A Arewa Youth Forum (AYF), South West Arewa Community (SWACOM), Senator Mohammed Sani Saleh, Barrister Ibrahim Bello, Hon Aminu Shagalia, Alhaji Suleiman Jere and Arc Ahmed Kabiru Abdullahi.

Others na Hon. Jalo Kollere, Hajiya Rabi Musa Saulawa, Malam Hamza Musa, Ahmed Mohammed Zagi, Hajiya Aishatu Yunusa, Ahmed Usman, Hajiya Aishatu Usman, Hon Muhammad Abubakar Mamadi, Hajiya Aishatu Yahaya Gusau among several others.

Di elders make dia position known shortly after dia convention for Arewa House inside statement wey di chairman, Suleiman Usman Jere read.

Also, di elders express worries say di LP presidential candidate continue to display anti-democratic tendencies, wey fit cause civil disobedience and threats.

You fit go read di tori about Arewa Elders political concern…READ MORE