Railways: FEC approve N495m to buy and install luggage scanners
About N495m na hin di Federal Executive Council, FEC don approve for di procurement and installation of luggage scanners for railway stations wey dey located for Abuja, Kaduna and Kano states.
Ademola Adegoroye, di Minister of State for Transportation, wey make di declaration on Wednesday after di Federal Executive Council meeting, explain say na to enhance security of lives and property for di railway facilities.
According to am, di devices wey dem go put for at railway stations for Idu, Rigassa, Kubwa, Jere, Kano and Kaduna include eight colour imaging x-rays, eight body scanners walk through metal detectors and 50 handheld scanners for effective security network.
Also, hin yarn say in view of di process of security of lives and property, dem need to install di equipment for railway stations.
FOR MORE NEWS: Imo guber: My nomination dey divinely orchestrated – PDP Anyanwu
In addition, hin yarn say as dem wan start di railway revolution, dem dey trying to put in place a lot of things.
Also, di federal government no want make pipo come spoil all di things wey di government dey try put in place or dat sector.
You fit go read di tori as FEC approve N495m for railway…READ MORE