‘Hidden agenda’ – Gov Ortom don call for suspension of 2023 census
Benue State Governor, Samuel Ortom don call on di Federal Government for di suspension di proposed National Population Census wey dey scheduled for May 2023.
Ortom make di call for Census suspension on Wednesday when hin receive a delegation from di Middle Belt Forum wey dey led by di President, Dr Bitrus Pogu for Makurdi, di state capital.
Di Governor, wey claim say hidden agenda fit dey ground on di on the conduct of di census, ask di FG make dem stop di exercise until di Internally Displaced Persons, IDPs, return to dia house.
Also, hin yarn say make dem stop di census until dem restore security and all di IDPs return to dia ancestral homes to get di opportunity to dey counted for dia homes of birth.
FOR MORE NEWS: Japa: ‘You go discourage students from reading Medicine’ – NMA oppose five-year compulsory practice
In addition, hin tok say he understand from di National Population Commission say those to be counted must be counted for dia localities”.
Also, di state get di worst record of herdsmen attack for di country, with thousands of persons wey dey killed within a year.
Benue get over two million persons wey dey live for different IDPs camps across di state.
Barely one week ago, di dreaded killer herdsmen invad one of di IDP camps and dem kill at least 35 persons.
You fit go read di tori…READ MORE