fbpx
November 16, 2024

PDP vs APC: Atiku beg voters for Adamawa, Kebbi

atiku-beg-adamawa-and-kebbi-voters

Presidential candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) Atiku Abubakar, on Thursday, beg voters in Adamawa and Kebbi States.

Di Independent National Electoral Commission (INEC) fix April 15 for supplementary elections for di states.

Also, di election go dey conducted for five senatorial districts, 31 federal constituencies and 58 state assembly constituencies.

Inside statement by hin spokesperson Paul Ibe, Atiku tell di electorate make dem support hin party standard bearers.

FOR MORE NEWS: APC wan do direct governorship Primary for Kogi State today.

“I make a special appeal to voters to ensure that PDP enjoys overwhelming support,” Na wetin di former Vice President tok be dat.

Also, for hin home state Adamawa, 36,935 voters for 69 polling units (PUs) na hin dey expected, according to di Resident Electoral Commissioner (REC), Hudu Ari.

PDP Governor Ahmadu Fintiri dey seek re-election, though hin dey face strong contender, Senator Aisha Dahiru of di All Progressives Congress (APC).

For Kebbi, 94,209 voters for 142 PUs dey expected to cast dia ballot to determine di winner between APC Nasir Idris and PDP Aminu Bande, a retired General.

You fit go read di tori as Atiku beg voters…READ MORE