Hakimi: Satan agenda dey spread — Ghanaian preacher
One Ghanaian preacher, Nanasei Opoku-Sarkodie, don condemn di widespread commendation of Moroccan footballer, Achraf Hakimi because hin dribble hin ex-wife, Hiba Abouk for dia divorce process. Hin tok say Satan agenda dey spread. Dis na as di footballer put all hin assets for hin mother name to deny di mother of hin two kids a juicy divorce settlement.
As hin dey address hin congregation for recent video, Prophet Opoku-Sarkodie yarn say di thing wey di PSG star do na Satan agenda for women to labour with men and get nothing in return.
Also, hin claim say Hakimi dey demonically married to hin mama.
FOR MORE NEWS: “I wish I can slap you” – Tonto Dikeh don drag unknown married friend
“Do you know what the devil is putting in the air now? That thing satan has spread is going to make a lot of women labour with men and get nothing”. Na wetin hin tok be dat.
According to di preacher, na spiritual contradiction with scripture wey Christians follow dey celebrating. Hin tok say man go comot for hin papa and mama house and hin gho join body with hin wife. So, anything wey dem labour for na for di two of them.”
As di clergyman yarn say Satan agenda dey spread, hin add say time go come when satan go program men to start to will dia properties to dia mama.
You fit go read di tori …READ MORE