fbpx
November 17, 2024

Nigerian groom surprise hin bride with Canadian permanent resident card on wedding day

nigerian-man-surprise-hin-bride

One Nigerian man don surprise hin bride with a wedding present far above anything wey she fit even imagine.

Di groom present her with a permanent resident card for Canada when dem dey do dia wedding reception.

When hin give her di card, she bin happy like say tomorrow no dey, and all she fit do na to laugh without control as she look di card.

FOR MORE NEWS: “Yoruba is so important to me” – Asake don explain why hin dey sing in Yoruba

Di man go down on one knee to offer hin wife di big surprise.

After di emotional presentation, di couple hug dia sef before dem go thank dia parents.

You fit go read di tori as Nigerian man surprise hin bride…READ MORE